Before I proceed I must make something clear. For Pete’s sake ‘I AM’ and ‘AM’ have TWO DIFFERENT MEANINGS. It is just one-kind to apply them to the same thing. E.g I am a girl & Am a girl. Do you see the problem here? Ehn? For those that can abbreviate ‘is’ sef, ‘I AM’ can be shortened to “I’M”. Somehow it irks me when I see this phrase being abused and massacred. So please people for my sanity just use “I’M”. Thank you
**************************************************
I don tire for dis wahala. Na evriday all dis polic pipu dey colect moni,if no b police pipu na agbero pipu. My bus na 14 seater bus and na N70 I bin dey collect from customa bifor but now wey e bee say na 2 pipu dey collect money from me befor I reash last busstop I kon incriz am to N100. Customa dey complain but last last dey con gree wen dey seee say all of my fellow bus pipu incrize moni too…
Na N1400 I supose to dey make from each journi now o but by d time I gv all dose thif pipu (agbero and police) I go make N1200,I go con pay my condukto N500,dat mean say nah N700 I dey get from eash jouney now. If God hellep me I go go 4 to 5 times(wen ma turn reash for park),dat mean say nah at least N3500 I bin dey make everyday.
D house I dey live don scatta. Dem talk say dey no build am well and one day wen I dey road my wife call me and talk say all her belonging don scatta wd d house,dat she manage escape wd our pikin sef. E no b like say na big house oh. Na house wey get plenty shop inside and my friend Emeka dey slip for for him shop,na him I dey manage wit. Now my wife and my pikin and me join dey squat for my bus-d only property I get for dis life.
I lovee my wife-Nkechi-no b small. She dey work hard. After our house scatter Nkechi start to dey do cleaner work for many place. Sometimes she dey make money pass me sef. God use Nkechi bless me well well. Sometimes wen everytin don tire me for dis life na she dey give me hope. Na she dey make me happi. But one tn I no like dat she dey do na say, her hope plenti too much. She beliv say Junior our pikin go fit go skul. I dey ask am wit wich moni we go fit do dat one,she too stubbon sef,she just no wan hear say we b poor pipu,say our powa no fit reash dat level. She beliv say Junior go big man for dis life,before I dey try stop am so she no go too dey tink like dat,so her hope no go scata but now I dey just look am. I don tire,mayb God go ansar am.hmmmm
I no dey waste my time dey tnk of tomoro. Na as everiday come I dey take am. Lastweek I find shortcut for road wey I go fit avoid all doz crasse police pipu,I make N5000,but yesterday dey com find d place. Chai! Na everywere dem dey poshu us go.I don tire. Dis life don tire me.
Now I dey look for room I go fit manage wit my family. Mama junior don mis her mensis and fear dey cash mi,sake of say if she get belle again I no go fit…I no go fit do anytn again. She no dey complain but mi sef I no say bus no b place were woman and pikin supose stay, I follow Chibuzo fight one day becoz he dey try sleep wit Nkechi. Wetin I go do now ehn? How I go take do am? I no wan fail my family but at d same time life too hard for me. Nkechi tok say make I do private driver,if e no work wetin I go do? All dz tn dey scata my hed,dey shook me for bodi. Hmmmmm…